Reading fans dey pass through alot ever since Dai Yongge buy di club, na from one wahala to anoda, if dem no commot points dem go fine Dai Yongge because e no gree pay Reading players and some staffs
According to reports, English football league don give READING FC owner Dai Yongge £20,000 fine for misconduct because e no gree deposit 125% of the club’s monthly wage bill.
Dem bin charge Dai Yongge around September 2023 because e no gree deposit money wey dem go use pay Reading players, soety EFL board come tok say dem suppose ban Dai Yongge for anything wey concern football for 12 months make dem see whether hin head go correct but Independent Disciplinary Commission tell EFL board make dem no suspend am because even if dem suspend am dem no sure whether e go gree bring out di money so make dem find anoda punishment give am.
Independent Disciplinary Commission say money dey Dai Yongge hand say di man no just won pay di salary while Dai Yongge dey tok say money no dey hin hand.
Fine wey dem give am now na £20k so dem suspend anoda £50k fine till 12 January 2024 meaning if e no deposit di money till then say dem go give am anoda £50k fine.
The Chinese business man don dey find buyer since but buyer no gree come all the whole thing follow dey weak am even EFL say if buyer come now now say dem go even join hand make di deal work fast because dem don tire for Dai Yongge matter.
EFL board still tell Reading fans say dem no get issue with di club say na di owner dem get issue with because how owner go dey e no dey gree dey pay people wey dey work for am.
According to di statement wey EFL board release dem say:
” We hope say this latest sanction and di way wey we take dey threat Dai Yongge say wey go fine am again fit bring a resolution to the short-term issue of funding the deposit account, and e suppose provide some re-assurance to the management, staff, and players at the club, wey dey continue to dey act as outstanding ambassadors for Reading FC, despite di challenging circumstances,”
Dem bin commot 10 points from Reading hand because of di issue wey make Reading dey 23rd for Football league one table yet di owner still no gree pay but EFL believe say this fine go touch am small so that e go gree deposit money wey dem go use pay Reading players.