Just few months after Lionel win hin 8th Ballon D’or award wey make social media and football lovers begin praise hin name, Lionel Messi don don do anoda thing wey dem go use praise am again because e no easy.
According to Sotheby, dem don sell six shirts wey Lionel Messi wear during Argentina Worldcup title last year and money wey dem take sell di jersey fit pay salary of more than hin 23 Inter Miami team-mates.
Di six jersey na from di first half of 2022 FIFA Worldcup final, Semi Final, Quarter final, round of 16 and two group stage matches di only jersey wey dem no sell na di one wey e wear against Poland for final group stage match wey some people dey reason say e fit don use am exchange jersey from one of Poland players.
Dem describe di six jersey as โLionel Messiโs match-worn iconic light blue and white, vertical striped Argentina shirts from his historic 2022 FIFA World Cup run” and people wey auction am na one New York City based auction house wey dem dey call Sotheby.
Di jersey cost, dem sell everything for $7.8 million meaning dem sell per one jersey for $1.6M although Sotheby bin think say di jersey go break Michael Jordan 1998 NBA finals jersey record wey dem sell for $10.1 million last year but e no later break am but e no mean say dem no happy as dem take sell Lionel Messi jersey quickly.
According to Forbes, di second most valuable jersey wey dem auction na Diego maradona “Hand of God” jersey wey e wear for 1986 Worldcup and dem sell di jersey for $9.28 million around May 2022.
Ths six Lionel Messi jersey wey dem sell yesterday don break di record for the most valuable Lionel Messi item wey dem auction, di Messi item wey hold di record before na di Jersey wey e wear against Real Madrid in 2017 and dem sell am for $450,000 then.
Lionel Messi still dey break records every day, e never tey wey e win hin 8th Ballon D’or award e don still make di final list of people wey go battle for Men’s FIFA player of di year award wey some people still dey pray make Lionel Messi win am again.