Some Birmingham City football club fans don come out again dey para dey cry for help after dem lose 2-0 against Coventry City yesterday.
Birmingham bin find Coventry City go CBS Arena make dem see whether dem go fit see away win because e don tey wey dem win away match but as dem reach CBS Arena wetin dem come dey see come dey different from wetin dem carry for mind go there.
Na former Aston Villa player wey just dey come back from 10 months injury wey im name na Callum O’Hare score di two goals wey help Coventry City beat Birmingham yesterday wey be 8th December 2023.
The lose wey Birmingham City lose don vex some of their fans soety some of dem come dey vex say Birmingham no suppose sack their former coach wey be John Eustace because di man dey do well pass Wayne Rooney.
Since Birmingham City appoint Wayne Rooney as their coach things no come dey go as dem take plan am but di club owners still believe in Wayne Rooney na why dem still trust di process make Rooney calm down cook.
Since last two months wey dem hire Wayne Rooney, Rooney don coach nine games, lose six, draw two come win only one and di one na 2-1 win against Sheffield Wednesday since November 25.
Before Wayne Rooney enter, Birmingham City bin dey 6th for table but now dem don jump down to 16th for Championship table with just seven points behind Queens Park Rangers wey dey relegation zone.
Although Wayne Rooney no dey happy with di results wey hin dey get since dem appoint am but e still dey beg for more chance because e still get beta to offer.
After Coventry City vs Birmingham City match yesterday, Wayne Rooney come tell Sky sports for interview say:
” e dey disappointing and frustrating but we gats stand up and keep pushing, we know say we dey pass through alot, but We need to come together then work hard to pick up more points.We concede two sloppy goals. I think we play well when match just start but for the first goal we allow too much space for our penalty area.as for di Second goal, we dey work for training on how to defend the box but we no do am well today, we suppose dey play well for our opponent area, but aftr their second goal, na that time we come dey play beta ball na why I dey always ask my players wey dem no dey play like this everyday”
Rooney still tell Sky sports say:
” We go dey try to improve and keep working on di pitch make we see whether we go get beta results.we no dey do well now, – I get it, I understand that. We suppose start to dey collect points, e dey simple as that.”I know wetin dey on board even my players know”.
Despite say Wayne Rooney don explain tire with evidence some Birmingham City fans still no happy with am, see wetin some of dem dey tok for Birmingham City comment section:
@Emily Hewertson say: “Shey na every night we go dey lose?”.
@Filan say: Abeg make una wake me up anytime una sack Rooney
@Jessi_0001 say: 0.55 points per game since dem appoint Rooney, I dey sick.๐ข