Many things don happen for football but this one surprise some football fans because dem never see this kind thing before.
Wetin happen be say one Egyptian player wey dey play for Mansoura FC bin assault hin coach today just because hin coach bin commot am.
Di thing bin shele on Monday wey be 8 September 2024 when two Egyptian clubs wey dey for second divison bin dey play match and di name of di clubs na Mansoura FC and Arab contractors.
Arab Contractors bin dey lead 2-0 till 60 mintues before oga Alaa Nouh wey be Mansoura coach say make e put one player wey im name na Abdel-wahed.
According to reports, as dem put am inside 60 mintues na im coach come change am inside 70 mintues.
Di thing pain Abdel-wahed soety e begin cry for pitch na referee come dey beg am to commot for pitch.
As di bobo commot naso everybodi come dey beg am to calm down even hin assistant coach dey beg am join but e run commot for di assistant coach hand rush go meet hin coach come headbutt am join.
Watch di video for down
If no be people wey come hold am di bobo for wonjure di coach.
Although Mansoura FC later lose di match 3-0 and di lose still keep dem for bottom of di table but hin coach don still come out say if player no dey wetin e tell am do for pitch say e go commot am put another player wey dey ready to work.
According to reports, Mansoura FC president wey im name na El- Bassiouny don suspend Abdel-wahed and e go give feed back after dem finish their investigations.