Everbodi know say South American league get wahala for bodi but dem no expect make referee di carry gun dey enter pitch.
Because today na Thursday make I throw una back to 2015 when one referee bring out gun for pitch dey pursue players and coaches.
Di thing bin shele in 2015 when two amateur Brazilian clubs bin dey play match and di name of di clubs na Brumadinho FC vs Amantes da Bola and where dem bin dey play di ball na Minas Gerais( Brazil).
Di match dey rough soety players dey fear to hold ball pass 10 secs because dem dey fear make opponent no injure dem, dem play rough game till second half.
According to reports, one Amantes da Bola player come dey kick di referee dey push am because oga Gabriel Murta wey be di referee no gree give person wey do am foul red card.
As di bobo dey kick di referee naso di referee run go outside pitch come back carry gun come out side naso di player pick better race dey run e no even look back.
watch di video for down
Na later dem come tell di player say di referee na policeman na wey e get gun for house, dem beg referee tire both hin linesman and other coach beg am make e keep gun carry whistle because e never reach to kpai person.
After di match oga Gabriel Murta wey be di referee say e dey feel threathen na why e go carry gun make e secure imself first.