Manchester United go find Liverpool go Anfield today make dem see whether dem go fit see match win today because e don tey wey dem win Liverpool last for Anfield.
The last time wey Man United enter Anfield dem chop 7-0 wey be Manchester United biggest defeat in their history and I know sure say Man United fans fit forget about am easily.
The last time Manchester United score for Anfield na Jose Mourinho still be their coach and dem play di match on the 26th of December 2018 and di match later end 3-1 wey make dem sack Mourinho di next day.
Since that 2018 reach today Man United never score for Anfield despite say Solskjaer and Ralf Rangnick don coach dem since then even Erik Ten Hag team never score for Anfield.
The last Manchester United player wey score for Anfield na Jese Lingard and di bobo no get any team wey e dey play for as of today.
The last time wey Manchester United win for Old Trafford na 17th January 2016 and na Wayne Rooney score di only goal wey Man United take win that day.
See Man United record for Anfield since 2016:
โข January 17th 2016: Liverpool 0 – 1 Manchester United
โข October 17th 2016: Liverpool 0 – 0 Manchester United
โข October 14th 2017: Liverpool 0 – 0 Manchester United
โข December 16th 2018: Liverpool 3 – 1 Manchester United
โข January 19th 2020: Liverpool 2 – 0 Manchester United
โข January 17th 2021: Liverpool 0 – 0 Manchester United
โข April 19th 2022: Liverpool 4 – 0 Manchester United
โข March 5th 2023: Liverpool 7 – 0 Manchester United
As it stands, Liverpool still dey 1st for EPL table with 37 points while Man United dey 7th with 27 points so di both team go need di match.
Liverpool go welcome new players wey just dey return from injury while Manchester United go play today’s match without Bruno Fernandes, Maguire, Tyrell Malacia, Casemiro, Lisandro Martinez, Mason Mount, Christian Eriksen and Amad Diallo.