As 2023 AFCON don finish, CAF don already start di preparation of 2025 AFCON because time no dey again.
Dem suppose play this 2023 AFCON wey Ivory Coast win around June/July 2023 but CAF president later change mind say make dem play am this 2024 due to weather concerns for Ivory Coast.
So this AFCON wey finish on di 11th Febuary 2024, na 2023 edition so dem go still play anoda AFCON next year and di AFCON go shele for Morocco although CAF never give official date wey di AFCON go start.
First of all, dem go do di draw of 2025 AFCON preliminary round and di draw go shele for Egypt tomorrow wey be 20th February 2024.
โข Na eight countries go play di preliminary round and di countries na eight (8) lowest ranked team according to FIFA ranking.
โข Di eight countries na Somalia, Djibouti, Sao Tome, Chad, Mauritius, South Sudan, Liberia and Eswatini.
โขDem go play di matches home and away, dem go play di match on di 18-26th March 2024.
โข Di four countries wey qualify for this preliminary round go follow di remaining 44 teams play di 2025 AFCON qualifiers(na 48 countries dey play di qualifiers).
Incase you don forget, di AFCON go shele for Morocco next year and CAF never give official date wey di tournament go start.