Because AFCON tournament won start, i won tell una some tori about Asuquo Ekpe wey be the first Nigerian player to score a goal for African Cup of Nations (AFCON).
Nigeria play their first ever AFCON tournament in 1963 and di tournament bin shele for Ghana and people wey still win di tournament na still Ghana wey host am.
Ever since Nigeria play their first AFCON tournament in 1963, dem don do things wey people no fit forget and one of di things wey Nigerians no fit forget na the person wey score Nigeriaโs first ever goal in the competition and person wey score di first goal na Asuquo Ekpe.
Short tori about Asuquo Ekpe:
Asuquo Ekpe play hin first international match for Nigeria on di 6th Oct,1956 against Togo. Asuquo Ekpe still play for many clubs and di name of clubs wey hin play na Welch XI, Lagos Railways, Secretariat FC, Ibadan Lions, and Western Rovers.
Asuquo became the first Nigerian to score in the Africa Cup of Nations after e score around 73rd minute against United Arab Republic (Egypt), but Egypt later win di match 6-3.
Nigeria still lose their second game and wetin pain Nigerians then be say people wey win dem na Sudan, no be only that, Sudan beat Nigeria 4-0 and di lose make Nigeria commot for di 1963 AFCON tournament wey shele for Ghana.
After di match, Jorge Augusto Pena wey be Nigeria coach then carry hin 18 players wey e carry go di tournament dey go back home because dem don commot for di tournament, incase you no know, Jorge Augusto Pena na Brazilian man.
Asuquo Ekpe play 24 games score 14 goals”for Green Eagles( now Super Eagles) during his career, and e play for Nigeria from 1956 to 1963 according to Wikipedia.
Asuquo Ekpe na senior brother of another Green Eagles star wey im name na Effiong Ekpe and nephew of the famous Etim Henshaw, wey play for Duke Town Primary & Secondary Schools in the 1940s-1950s and na im be the captain of the first national team wey tour UK in 1949.
In the match against Dahomey on 2 Feb,1963, Asuquo & Effiong Ekpe create anoda history, dem become di first siblings to play for Nigeria in the same game.
Asuquo Ekpe later die on di 30th of January 2016 in calabar.