Sports Kenya don use vex give Gor Mahia Football club beta fine because of wetin dia fans do against Muranga Seal fc last week Saturday.
Di whole wahala start after one Gor Mahia fan enter pitch make e go fight referee because dem say dey referee dey blow ojoro and e commot goal wey Benson Omala bin score wey make di match end 0-0.
Naso di wahala take start, some Gor Mahia fans come begin dey uproot chairs dey scatter things for stadium wey make security officers come begin dey fire tear gas and rubber bullets to calm di situation.
Before dem go settle everything Go Mahia fans don already spoil plenty things and wetin dem scatter for Kasarani Stadium plenty na why dem give dem Ksh2 million fine.
Dem say Gor Mahia fans spoil 295 seats so dem go pay Kshs 5,000 for dose seats wey dem spoils, dem still tok say dem spoil wooden panels and electrical panes so if dem calculate everything together say wetin Gor Mahia go pay na Ksh2 million.
Dem still tok say Gr Mahia FC go write letter send give Sports Kenya and inside that letter Gor Mahia go explain how dem go take stop dia fans from behaving like agberos and if dem no submit di plan say dem no go allow Gor Mahia fans enter di stadium again.
Dem still tok say Gor Mahia no go use Sports Kenya facilities again untill dem pay di Ksh2 million fine.
According to Pulse Kenya, some Gor Mahia FC players go face disciplinary actions because dem won follow attack match officials that day, players like Benson Omala, Rooney Onyango, Joshua Onyango and Rodgers Ouma.
Although Gor Mahia FC fit appeal but for now dem never make any move to appeal di judgement