Lionel Messi fans don use vex attack Popular Nigerian Police officer wey say dem no suppose compare Cristiano Ronaldo with Lionel Messi because Ronaldo beta pass Messi by far.
The whole wahala begin after Cristiano Ronaldo score one outside 18 yards goal wey help Al Nassr win Al-akhdoud few days ago and di goal still help Cristiano Ronaldo to set another record as all time top scorer in the history of top divison league football.
The goal wey Ronaldo score surprise everyday because people still dey wonder how Ronaldo take see road score Al-akhdoud goal-keeper from far place like that, di goal surprise everybodi including Delta State Police Commission PRO wey im name na Mr Bright Edafe wey make am use hin official X (Twitter) account dey para for people say make dem stop to dey compare Ronaldo with Lionel Messi because Ronaldo don prove himself as the best player.
Officer Bright Edafe say:
” Dem no suppose dey compare Ronaldo with Messi, how you go dey compare person wey don prove himself at all stages and level, with different clubs with Lionel Messi wey be one club player, as in how?, wetin Messi dey do for USA?, You fit compare?”
The post no sit well with some people soety Daniel Regha wey People know as person wey dey choke mouth for wetin no concern am come even dey tell di police officer to leave football matter make e concentrate for hin police work.
See wetin some Nigerians tok for di officer comment section:
@Prince say: ” All these plenty toks no fit give Ronaldo knock out goal”.
@Adigun say: ” Olopa, tell am make e go prove imself for Worldcup”.
@Tableshaker say: ” Comparing Ronaldo with Messi dey like Comparing Nigerian Police with Nigerian Army, Ronaldo na military imself”.
@More life say: ” I like your postion and I dey respect am, my question na where Ronaldo Worldcup dey?, No Worldcup no debate sir”.
@Adewuyi say : “Make Ronaldo go prove himself for Worldcup”