Sadiq Umar bin follow Real Soceidad play against Osasuna for Copa de Rey round of 16 wey make some Nigerians begin dey wonder wetin happen.
Why Nigerians dey ask questions be say dem tell dem say Sadiq Umar carry injury and e no go play ball for three weeks na why dem won use Paul Onuachu replace for 2023 AFCON.
Days after dem replace Sadiq Umar, Real Soceidad come post video where Umar dey do personal training come caption am ” Recovery process” Nigerians no know say Sadiq Umar go play match yesterday.
Wetin come surprise Nigerians be say Real Soceidad later put Sadiq Umar around 72’mins against Osasuna yesterday and di thing don make Nigerians begin tok many things.
Some say ebi lyk Sadiq Umar fake hin injury while some say ebi like NFF medical teams wey declare Umar injured no sabi work, now, NFF don come out dey tok their own side of di story.
The Nigeria football federation (NFF) don come to clear di air concerning Sadiq Umar injury.NFF say:
“Our medical team calm down do test come check Sadiq Umar before we tell coach Jose Peseiro make dem withdraw Sadiq Umar from di 2023 AFCON squad”.
NFF say when Sadiq Umar enter super Eagles camp say di bobo no carry injury NFF say dem even do pre-competition medical assessment and dem see say Sadiq Umar dey okay but unfortunately e later carry injury for back of his left knee during Nigeria friendly match against Guinea wey shele for Abu Dhabi on di 8th January 2024 wey Guinea beat Nigeria 0-2.
NFF say when Sadiq Umar carry di injury na during that Guinea match and na di injury lead to di penalty wey Simon Moses miss that day.
NFF say when e carry di injury dem come tell Sadiq Umar make e commot for pitch di bobo say make dem no worry say e go fit continue di match, dem say even for half time Sadiq Umar still insist say e go play till 90 mintues.
NFF say Sadiq Umar later carry di leg like that play full 90 mins.But the next day, e come wake up come see say e knee don dey swell up, dem come apply ice block, na di same day dem come travel from Abu Dhabi come Lagos.
On di 10th January dem come fly enter Ivory Coast naso di leg swelling come dey too much naso dem come decide say make dem withdraw am from di squad so dem dey surprise say people come dey tok anoda thing online.
Uptill now Sadiq Umar never respond or tok anything about di mata but many Nigerians don tell NFF and Nigerians say make dem forget about Sadiq Umar matter because e don pass be say e don pass so make Nigeria focus on their next match wey be Ivory coast.
Meanwhile, Nigeria go play Ivory Coast today but dem go play dem without Yusuf Alhassan but di good news be say Terem Moffi, Iheanacho and Paul Onuachu fit play because dem don dey train ever since dem join their fellow teammates for camp.