Nigerians don happy tire after dem knock Cameroon commot for 2023 AFCON tournament but one thing still dey worry dem wey be Stanley Nwabali wey coach remove due to injury.
Some Nigerians dey vex because dem no won miss Stanley Nwabali for Quarter finals wey super Eagles go play against Angola next week Friday.
Nwabali na one kind goal-keeper wey dey control hin defense na im follow make Nigeria defense dey okay na only one goal Nigeria don concede for this tournament so far, na only Senegal, Mali and Morocco and Nigeria don concede di fewest for this competition.
Super Eagles defense strong soety Cameroon no get any shot on target till di match finish na why some Nigerians no won make anything scatter their defense and goal-keeper because all of dem understand demself.
After di match yesterday some Nigerians come dey worry about Stanley Nwabali injury although e later use hin leg enter pitch come follow hin teammates celebrate but see wetin Super Eagles coach wey im name na Jose Peseiro tok about Nwabali injury.
See wetin Jose Peseiro tok about Stanley Nwabali injury
” We go assess the state of Stanley Nwabali’s injury in the next 24 to 48 hours. e dey difficult to assess hin condition when match still dey go on but I dey hope say e go dey fit for di next matchโฆ I won make hin play. And the players won make hin play.โ via Osasu Obayiuwana
Jose Peseiro still tok about Super Eagles 2-0 win against Cameroon, e say:
” Our football sometimes dey incredible, we play well, today we created less chances but we score two goals”
See wetin Peseiro tok when dem ask am whether Nigeria level go drop against small country like Angola because Super Eagles dey play well against bigger nations:
” See, I just won win every game, I no know about wetin Nigerians dey think about names in football but if we won win Angola, we must play like we play today”
Nigeria go meet Angola for Quarter final and di match go shele next week Friday, both Nations reach Quarter finals after Nigeria 2-0 win against Cameroon while Angola Knack Namibia 3-0 that same yesterday.
Nigeria and Angola never meet for any major tournaments, although dem don meet 8 times but na for Worldcup qualifiers and AFCON qualifiers.
Inside di eight matches, Nigeria win two while Angola win two dem come play four draws inside di eight matches.
As Nigeria still dey pray for their goal-keeper, Angola go play their Quarter final match without their first choice goal-keeper wey im name na Neblu, Neblu collect red card against Namibia after e use hand carry ball outside di Penalty area.