Year never go far but we just dey experience vawulence, from one vawulence to anoda but this time around na Khvicha Kvaratskhelia agent and Victor Osimhen.
Dem say 2024 slogan na ” no gree for anybody” and di way Victor Osimhen take reply Khvicha Kvaratskhelia agent show say Victor Osimhen no fit gree for anybody this year.
Wetin really happen between two of dem:
Early this week, Khvicha Kvaratskhelia agent wey im name na Mamuka Jugeli come tok wetin pain some Nigerians for interview and wetin dey vex dem be say di man no be Victor Osimhen agent.
Mamuka Jugeli tell Georgian media 1Tv say:
“Victor Osimhen sign new contract, but shey you think Osimhen go fit spend hin entire career for Napoli? I won tell you say Osimhen dey go Saudi Arabia next summer. Napoli don increase Osimhen salary, but Khvicha no fit accept such transfer even for โฌ1 billion. Hin go prefer to play for Real Madrid, Bayern Munich, Barcelona or Manchester City. Kvaratskheliaย get different targets and preferencesโ
Wetin di man tok don vex many people soety dem come dey ask am wetin concern am for Victor Osimhen despite say e no be hin agent.
But today Victor Osimhen don use vex use hin official Instagram account reply oga Mamuka Jugeli say:
“Dear Mamuka Jugeli, you are a piece of filth and a disgraceโ.”I’m embarrassed at your sense of reasoningโ.โDumb f*ck! KEEP MY NAME OUT OF YOUR MOUTH!โ.
See di post here:
Di 25 year old Napoli and Super Eagles striker dey Lagos, Nigeria currently after their one week training for Abu Dhabi, United Arab Emirates last week.
Osimhen follow hin fellow Super Eagles team mates di send forth party wey Governor of Lagos State and NFF organize yesterday.
Super Eagles go dey prepare to go Ivory Coast like this and some Nigerian don tell Victor Osimhen make hin leave Khvicha Kvaratskhelia agent concentrate for AFCON wey go start on di 13th of January because all Nigerians get hope for where hin dey.