Nigerians don celebrate tire after Super Eagles of Nigeria win South Africa through Penalty shoot-outs wey help dem reach di final of di 2023 AFCON.
Before di match, Super Eagles bin announce say Victor Osimhen fit no play today wey make Nigerians come begin dey fear because Osimhen na hit man infact hin presence dey fear defenders but luckily dem later declare am fit yesterday and e later start match.
Jose Peseiro start di match with hin normal lineup wey be 3-4-3 di only changing wey e do na Bright Osayi wey replace Zaidu Sanusi.
As match start, South Africa come dey play Nigeria infact South Africa dominate most of di game soety Nigerians come dey wonder whether Nigeria fit win South Africa because of di wey we South Africa dey play dem.
William Troost-Ekong, Semi Ajayi and Calvin Bassey bin see small shege from di hands of Percy Tau and Evidence Makgopa but Las Las dem come out victorious because di two players no score.
Anoda player wey impress people today na Stanley Nwabali wey be Super Eagles goal-keeper, di Chippa United and Super Eagles goal-keeper save many balls wey help Nigeria win today’s match Infact e save penalty join today.
Na Nigeria first score di first goal of di match and di goal come around 65 mintues after Mothobi Mvala draw Victor Osimhen for 18 yards box wey make referee give Nigeria Penalty.
As dem give di penalty, Victor Osimhen carry di penalty give Troost-Ekong come still give am small advise join and Ekong no do mistake for di ball, baba score di penalty wey give Nigeria di lead.
Nigeria get beta chances to double their lead but dem miss am especially di one wey Lookman miss although Victor Osimhen later score around 88 mintues but VAR commot am come give South Africa penalty due to foul wey Yusuf commit for Super Eagles box.
Teboho Mokoena collect di penalty come score am wey make di match enter extra time, dem play di draw for extra time di ball enter penalty shoot-outs.
See as di Penalty shoot-outs take go
โข Terem Moffi of Nigeria first score hin own penalty
โข Mokoena of South Africa come miss hin own penalty.
โข Kenneth Omeruo of Nigeria come score hin penalty wey make am 2-0.
โข Mayambela of South Africa come score hin own penalty (2-1)
โข Ola Aina of Nigeria come play hin own penalty over di bar(2-1)
โข Makgopa of South Africa come miss hin own join ( 2-1)
โข Troost-Ekong of Nigeria come score hin own penalty ( 3-1)
โข Mvala of South Africa come score hin penalty ( 3-2)
โข Kelechi Iheanacho come score di last penalty (4-2)
Naso Nigeria take win South Africa through Penalty shoot-outs for Stade de la Paix Stadium wey dey for Bouake, Ivory Coast.
Nigeria go meet anybodi wey win for Ivory Coast and DR Congo match and di final go shele on Sunday wey be 11th Febuary.