The 14th edition of Globe Soccer Award wey some people know as Dubai D’or award go shele today for ATLANTIS THE PALM, Dubai and di award ceremony go start by 7pm Dubai time wey be 4pm Nigeria time.
Na since 2010 dem start dey give out Globe Soccer awards to footballers and person wey start this award na Tommaso Bendoni.
Dem bin start di first edition of di Globe Soccer Awards with three categories, dem come expand am to six in 2011 and to ten by 2012.
But since that 2012 reach now wey be 2024 dem don add more awards and di awards wey dem go give out today plenty.
See di awards wey dem go give out today:
- Best men’s player award
- Best women’s award
- Fans favorite player of di year award
- Best men’s club
- Best women’s club
- Best Coach
- Best midfelder
- Best goal-keeper
- Power horse emerging player
- Best Agent
- Best Football club president
- Best sporting direct
- Best middle East player
- Best middle East club
- Serie A best digital content by a player
- Serie A best digital content by a club
- Best EA sports player
- Best Digital Journalist
- Best social media influencer
- Best video creator
Inside this award wey dey here di main category wey football fans no fit use play na best men’s player of di year award and Women’s player of di award.
Dem go give all this awards to di nominees wey do well for 2023 and person wey fit collect di most award pass today na Cristiano Ronaldo.
Ronaldo fit win four awards today although e don already collect Maradona award because na im be di world top scorer in 2023.
And e still make di final list of fans favorite player in 2023, Middle East player of di year in 2023 and Best men’s player of di year award.
Since dem start this Globe Soccer award nobody don win am pass C Ronaldo because e don win am six(6) times and hin fans believe say e go still win today’s own.
Where you fit watch di award ceremony:
โขYouTube (youtube.com/@globesoccer)โ .
โข Website (globesoccer.com)โ
โข TikTok (tiktok.com/@globesoccer)โ
โข Mobile app (get.globesoccer.com)
And people wey go host di ceremony na Amanda Davies and Tom Urquhart.