Lionel messi bin win anoda award yesterday wey some football fans come begin dey wonder dey ask why Lionel Messi go win di award ahead of Erling Haaland and Kylian Mbappe despite say FIFA announce say dem no go use 2022 FIFA Worldcup performance as criteria.
The Best FIFA Football Awards bin shele for London yesterday night wey be 15th January 2023 and dem bin give out many awards to people wey perform well for football starting from 19th December 2022 to 20 August 2023.
See di list of people wey collect award yesterday
โข Aitana Bonmati – collect di Best FIFA women’s award
โข Ederson – collect di Best FIFA men’s goal-keeper of di year award
โข Mary Earp’s – collect di Best FIFA women’s goal-keeper of di year award
โข Pep Guardiola – collect di Best FIFA men’s coach of di year award
โข Sarina Wiegman – collect di Best FIFA women’s coach award
โข Guiherme Madruga – collect di FIFA Puskas award
โข Lionel Messi come collect di Best FIFA men’s player of di year award
The award wey Lionel Messi collect yesterday don cause commotion for social media wey make some people come dey ask why Lionel Messi go win di award ahead of Erling Haaland and Mbappe.
See how Lionel Messi take win the award
โข FIFA say dem go give di award to best performing player from 19th December 2022 to 20 August 2023
โข People wey go do di voting na National team captains, National team coaches, expert Journalist and fans, and dem start di voting from 14 September 2023 to 6 October 2023.
โข If dem pick/vote you as first choice you go collect 5 points, second choice go collect three points while di third choice go collect one point.
โข National team captains like, Salah, Mbappe, Ramsey, Andy Robertson and Jonny Evans pick/vote Lionel Messi as their first choice wey suppose win di award.
โข After di voting, Lionel Messi get 48 points, Erling Haaland collect 48 points while Kylian Mbappe wey be 3rd position collect 35 points.
According to FIFA, wetin make Lionel Messi win di award ahead of Erling Haaland be say number of National team captains wey pick Lionel Messi as their first choice plenty pass di national team captains wey vote for Erling Haaland.
FIFA rule for di award (via no 12) say if people wey make am to the final of di award get the same points say dem go use amount of votes from national team captains to determine who go collect di award and for national team captain voting, Lionel Messi collect 107 points while Erling Haaland get 64 points.