Some Slovenia football fans don vex tire after dem see wetin shock them for their league match on Saturday and some of dem don already dey para say make dem sack di coach.
Wetin happen be say, two Slovenian clubs be di play league match on Saturday wey pass and di name of di both teams na Rogaška FC and Olimpija FC.
Rogaška FC really need di match because dem dey last for table and dem never win match in their last nine league games wey dem don play.
To make di matter worse, Rok Vodisek wey be Rogaška FC first choice goal-keeper no fit play di match due to injury so dem no get any other choice than to use anoda person play di match.
Olimpjia wey dem won face dey 2nd for Slovenian table and dem dey inform so Rogaška FC coach wey be Oskar Brobne wey come dey confused because e first choice goal-keeper no dey available coupled with di new rules wey Slovenian FA bring last season.
When di match start, e no reach 29 seconds naso one Rogaška player come play ball commot for pitch people come dey surprise whether person don carry injury abi di player no know wetin e dey do.
Before you know wetin happen, Rogaška FC come commot their 17- year old goal-keeper wey im name na Sam Lorber come put Adjin Mulalic wey just join di team this January.
Fans wey dey for pitch come dey wonder wetin fit happen because di bobo no carry injury while some people wey know wetin happen no too worry.
E get wetin make Rogaška FC coach commot di bobo and if e no remove am e fit break one rules wey Slovenian FA set.
According to di new rules wey Slovenian FA break, The rule make am compulsory say every team must start one player wey dey eligible to represent Slovenia for under-21 level.
Although di rules no tok when you fit commot di player or not but wetin dem know be say you must start one player wey dey eligible to play for Slovenia Under 21.
The match later end 2-2 after Rogaška FC bottle their 2-0 lead, and di draw make Rogaška balance for last postion(10th) with 12 points, Rogaška FC don play 20 League matches this season, win 3, draw 3 lose 14.