Former Barcelona and PSG defender wey im name na Dani Alves bin go trial for one court wey dey for Spain and di trial start today wey be Monday, 4th February 2024.
E don reach one year wey dem arrest Dani Alves so dem don finally carry am go court today, wetin make dem arrest am be say one girl come allege say Dani Alves sexually assault here for one night club wey dey for Barcelona.
Di woman say di Brazilian star assault her for di night club wey dey for Barcelona on di 31st December 2022 and Dani Alves don deny am too.
Camera bin capture when Dani Alves enter court room with hin white shirt and jeans and hin mama still follow am enter di court room and dem go finish di trial on Wednesday.
State prosecutors say dem won make dem give Dani Alves nine-year prison sentence while lawyers wey dey represent di lady wey accuse Dani Alves say e want make dem give Dani Alves 12 years prison sentence.
Police bin arrest Dani Alves on di 20th January 2023, after police invite am when e visit Spain, one court for that Spain come order say make dem jail Dani Alves after dem analyze di initial police investigations and wetin di victim and Dani Alves tok.
Three days after dem arrest am, dem come transfer Dani Alves to Brian 2 prison wey dey for Barcelona and officials wey transfer am to Brian 2 prison say dem carry am go there due to safety reasons and na for that Brain 2 prison e don dey reach now.
According to reports, Dani Alves come request for bail, court come deny di bail, dem say Dani Alves fit japa despite say Dani Alves don agree to give dem hin passport and e still tell court say e go dey wear Tracking device dem still no gree because Brazil no fit extradite their citizen go anoda country make dem sentence am.
According to di evidence wey dem give state prosecutors, di woman say she jam Dani Alves for Sutton night club wey dey for Barcelona, she say after everything, she come escort Dani Alves go di VIP area from there dem enter di VIP bathroom where Dani Alves dey slap her, rape her come still use insulting language for her.
When Court first ask Dani Alves, Dani Alves allegedly deny say e never see di girl before infact e say e never see di girl for anywhere Infact e no know am e still deny everything wey di lady tok but three months later, e come admit say e do some things wey di lady tok but say di lady dey aware say e won sleep with am and wetin make am no accept before be say e dey try to save hin marriage.
Dani Alves don change lawyers three times and lawyer wey go represent am for this trial wey start today na Ines Guardiola and e hire am last year October while di lawyer wey go represent di alleged victim na Ester Garcia and na three judges go handle di trial.
28 witnesses go give their own testimony between Monday and Tuesday before di court go hear from experts on Wednesday.
The court don still order say di evidence wey di accuser go carry come go be behind closed doors and dem no go snap her picture because dem won protect her image because.
more details later….