Super Eagles and Real Soceidad striker wey im name na Sadiq Umar don finally come out tok hin side of di story after some Nigerians come dey tok say e fake injury for Super Eagles camp because e won go back to hin club.
Before AFCON start, Super Eagles bin use Paul Onuachu replace Sadiq Umar due to injury and dem say Sadiq Umar no fit play ball for three weeks because of di knee injury na why dem replace am quickly.
E no reach four days wey dem replace am from Super Eagles camp Real Soceidad come post video for their social media accounts say Sadiq Umar don start hin recovery process wetin come shock Nigerians be say Sadiq Umar still follow Real Soceidad play Osasuna for Copa del Rey match wey Real Soceidad win 0-2 and Sadiq Umar enter di match as substitute around 72 mins.
As di match finish, some Nigerians come dey tok many things, some say Sadiq Umar fake injury say make dem no call am back while some say make dem no blame Sadiq Umar say di fault from come from NFF medical teams hand.
As di tori come dey spread for social media NFF come release statement say their medical teams calm down check Sadiq Umar before dem tell super Eagles coach say make dem replace am.
Now Sadiq Umar don come out tok hin own side of di story because many people don dey tok anoda thing.
Sadiq Umar use hin official Instagram account release statement yesterday and e tok for di official statement say no be hin fault because e no fit just run commot for camp go dey play for hin club.
Sadiq Umar say e carry di injury for friendly match wey Nigeria play against Guinea and e carry di injury when two Guinea defenders kick am and di incident result to penalty wey Moses Simon later miss.
E say despite say medical team tell am make e no continue di match e still insist say e won play till 90’mins and e later play di match till 90’mins.
Sadiq Umar say di next day, hin knee come dey swell up wey make Super Eagles medical team come do examination come tell am say na Meniscus injury wey make Super Eagles coach replace am base on wetin Super Eagles medical team assessment show am.
Sadiq Umar say after di whole thing, e come return to hin club wey be Real Soceidad, di club medical team come do their own scan come tell am say na just bruise so dem come tell am to resume training di following day.
Umar still tok how e no fit use Super Eagles play come still tok say e dey pain am because e no dey with Super Eagles for this AFCON but e dey wish Super Eagles well.