Ghana Police don announce say dem don arrest one man wey dem identify as Seidu Musah alias Gaswan because dem dey suspect say e follow beat Nsoatreman FC coach wey im name na Mr.Maxwell Konadu.
According to Ghana Police service, dem allege say Seidu Musah and one other suspect follow attack coach Maxwell Konadu on Sunday wey be 19th November 2023 after Nsoatreman FC vs Bofoakwa Tano match wey shele for Sunyani Coronation park.
Ghana Police say di Suspect wey be Seidu Musah dey dia custody while dey other person still dey run like fowl wey dem commot hin head so Seidu Musah go dey assist dem dey do Investigations till dem catch everybodi wey follow beat Coach Maxwell Konadu enter hospital.
The whole thing happen on Sunday for Suyani Coronation park wey dey for Ghana when two Ghana Premier league Clubs wey be Nsoatreman FC and Bofoakwa Tano FC bin dey play match.
Di match later end 0-0, as referee blow di final whistle naso Bofoakwa Tano fans enter pitch come dey attack everybodi, some reports say dem attack both referee and some of Nsoatreman players but na Nsoatreman coach own worst because dem beat am enter hospital.
Video when Bofoakwa Tano fans dey attack People for pitch:
Dem beat di coach soety e fall e no come dey feel imself again naso peopkywey dey around run carry coach Maxwell Konadu go Sunyani Teaching Hospital na dia e dey collect treatment till e get imself wey make dem discharge am yesterday.
Reports say Ghana Football Association (GFA) don give Bofoakwa Tank temporary ban from using Sunyani Coronation Park so dem go find another Stadium till dem settle this matter.
Nsoatreman FC still dey 2nd with 20 points after 11 games while Bofoakwa Tank dey 6th with 16 points and e don tey wey Bofoakwa Tank don win match na wetin follow make some people dey reason whether na lack of winning make dia fans vex on Sunday.