The professional game match officials limited (PGMOL) don calm down explain give some Liverpool fans wey still dey vex say referee no give Liverpool penalty on Saturday match against Arsenal despite say Martin Odegaard hand touch ball for Arsenal 18-yard box.
Liverpool vs Arsenal bin play important match wey suppose decide who go balance well for 1st position for EPL table but di both teams no gree for each other na why di match later end 1-1 draw.
Na Gabriel first score for Arsenal inside 3 mintues with a good header and e no reach 20 mintues why Liverpool suppose equalize through penalty but referee no gree give dem di penalty.
Liverpool player wey im name na Mohammed Salah bin carry ball make e go score unfortunately, di ball come touch Martin Odegaard for hand wey make Liverpool players come dey protest for penalty.
The replay show when di Norwegian midfielder bin won turn e come do mistake slip inside Arsenal box wey make ball touch hin hand and di incident don make some football fans dey tok many things.
despite say di ball touch hin hand, di center referee wey be Chris Kavanagh say e no fit give Liverpool penalty because di ball no be penalty even oga David Coote wey be VAR official agree with di center referee say di ball no be penalty.
After di match, PGMOL come explain why referee no give Liverpool penalty, PGMOL tell Skysports say:
” Why referee no give Liverpool penalty na because Martin Odegaard arm dey move towards hin bodi if to say e bodi dey move towards di ball dem for give Liverpool di penalty”.PGMOL confirm say di ball touch Odegaard for hand but na because e use di hand to balance imself and hin arm dey move towards hin bodi na why dem no give Liverpool di Penalty because dem calm down check am come see say no be penalty offence.
Despite say dem no later give Liverpool di penalty, Mohammed Salah later score one fine goal wey help Liverpool equalize for first half all thanks to Alnord wey do di fine assist wey Salah take score.
The 1-1 draw make Arsenal dey top EPL table with only one point wey Liverpool and Aston Villa dey behind Arsenal with only one point.