All African countries wey go participate for this upcoming Africa Cup of Nations (AFCON) wey go shele for Ivory Coast next year dey do pre-AFCON camping make dem use am train still from their select players wey dem go use play di AFCON tournament.
Some Nigerians no dey happy, wetin dey vex dem be say their country dey go camp for Dubai, UAE wey be say di AFCON tournament wey dem won play go shele for Africa.
Dem say Super Eagles suppose find one country for AFCON camp since di tournament wey dem dey prepare for go take place for Africa no be only that, dem say money no too dey country atleast if dem camp for Africa dem go save small money.
Meanwhile, Super Eagle go camp for Dubai before di AFCON, dem go play Burkina Faso and Cape Verde before di first AFCON match wey go shele on di 14th January 2024.
No be only Nigeria go camp outside dia country, some country go still camp for anoda country before di tournament.
Names of country and where dem go camp before AFCON:
โข Cameroon – Saudi Arabia
โขGambia – Saudi Arabia and Morocco
โขGhana – South Africa
โขAlgeria – Togo
โขMali – Mali
โขDR Congo – Abu Dhabi
โขBurkina Faso – Abu Dhabi
โขNigeria – Dubai
โขGuinea Bissau – Mali
โขNamibia – Ghana
โขZambia – Saudi Arabia
โขSenegal – Senegal
โข Angola – Dubai
โข Tanzania – Egypt
โข South Africa – South Africa
โขEq. Guinea – Eq. Guinea
โข Egypt – Egypt
โขMorocco – Morocco
โขTunisia – Tunisia
โข Guinea – Abu Dhabi
โขCape Verde – Abu Dhabi & Tunisia
โขMauritania – Tunisia
โขMozambique – South Africa
Credit: Nuhu Adams.
Nigeria go play Burkina Faso and Cape Verde for friendly match while Ghana go play Botswana in South Africa.
Burkina Faso go play Democratic Republic of Congo and Nigeria while Egypt go play Tanzania more countries go announce people wey dem go play with very soon.