No be small shege Man United don show some people, some don lose many bets while some don dey get HBP because of man United now one Nollywood Actress wey her name na Victoria Inyama don come out tok how she take dey chop beating form her ex husband hand anytime Manchester United lose match.
The Actress get three children with hin ex husband wey people know as Godwin Okri but dem don break-up due to some reasons.
According to di recent podcast wey Victoria Inyama do with Chude Jideonwo she calm down tok di kind shege wey she see from her ex-husband hand see even tok how hin ex-husband take carry anoda woman come house.
She still tok anoda one wey make am di fear Man United till today, according to wetin she tell Chude Jideonwo for di podcast, she say:
” I tell my pastor say this guy beat me one day because one certain football team lose, e get one day wey hin football team lose, e rush use vex off television, I come ask am as you don off this television now wetin you want make we dey watch, e use vex reply me say whether na my papa get di television abi na my mama carry di television come di house,I come dey in pains, na why I hate that football team ehh”.
Immediately she tok finish naso Chude wey be di Interviewer come ask her wetin be di name of di Football team naso she reply am say:
” Na Manchester United, I hate Man United because di number of beating wey I don collect because Man United lose match ehh,even uptil today anytime wey dem get football match and Man United lose I go dey praise God because I for don chop beating, even my son go dey laugh join because if to say wey still dey with my ex husband we for don chop beating”.
Many Nigerians wey don watch di podcast don gather dey para for Man United while some say she get luck say no be now wey Man United dey lose match wella if not she for don chop beating tire.
Ikokwa Chidozie say: ” Na disturbing news, Man United from today, you no go win match again”
Malik UDU say: “My dear I no suppose laugh but e funny die”.