Super Eagles do wetin shock so many Nigerians today after dem get mind knack one Abu Dhabi local team 12-0 today, no be only that, Francis Uzoho keep clean sheets today.
Although di match na Unofficial match but Super Eagles use am prepare for AFCON tournament wey go start on di 13th of January 2024 and di match no mean say Super Eagles no go play their friendly match with Guinea tomorrow wey be 8th January 2024.
The team wey Super Eagles beat 12-0 today na one Abu Dhabi local team wey dem dey call Al Gharbia Sports Football club and di match shele for Cricket Stadium wey dey for Abu Dhabi, United Arab Emirates.
According to reports from Own goalNigeria, Nigeria first beat dem 6-0 for first half and people wey score di goals for first half na Ademola Lookman and Victor Osimhen.
Lookman score four goals and Victor Osimhen score two goals for first half wey make di match end 6-0 for di first half.
As second half reach, Moses Simon come score two goals, Sadiq Umar score one, Ahmed Musa score one while Al Gharbia Sports Football club players come score two own Goal due to how Super Eagles take dey press dem.
Super Eagles starting XI na:
โข Francis Uzoho
โข Zaidu Sanusi
โข Ola Aina
โขChidozie Awaziem
โขCalvin Bassey
โข Joe Aribo
โข Frank Onyeka
โข Ademola Lookman
โข Ahmed Musa
โข Sadiq Umar
โข Victor Osimhen
source: Owngoal Nigeria
Dem play di match for behind closed doors na why pictures never come out at di time of this reports, but Al Gharbia sports don confirm say dem go release di pictures of di match through di official Instagram accounts.
Nigeria go still play Guinea for pre-Afcon friendly match tomorrow, after di match, dem go come back to Lagos, Nigeria on di 9th wey be Tuesday before dem come fly to Ivory coast on di 10th of January 2024.