Reason why some clubs from Wales dey play for English league plenty and dey clubs no gree go back again
some people think say na all clubs wey dey English Premier League and Championship na English clubs dem no know say some clubs na visitors for England, clubs like Cardiff city and Swansea City.
How e take happen
Dem created Cardiff Football club in 1899 come still create Swansea City in 1912 both of dem na Welsh clubs.
When dem create both of dem, Wales neva get dia own league na im make Cardiff City go meet English FA in 1920 say dem won join English Football league.
Afer Cardiff join finish, Swansea City go meet English FA in 1921 say dem won join English Football league naso the two Welsh clubs take dey play for English League.
Wales later create dia own league in 1922 come dey beg Cardiff and Swansea make dem join back but di two clubs reject di proposal say dem no go join dem because dem like English Football League.
In 1927, Cardiff become di first non English team to win the FA Cup after dem win Arsenal 1-0 for FA cup final wey shele for Empire Stadium (Wembley stadium now).
Swansea City na di first Welsh club wey don represent England for European competition after dem win Bradford City 0-5 for League cup final wey shele for Wembley stadium and di match help dem qualify for Europa league qualifying round.
No be only Cardiff and Swansea be di only Welsh clubs wey dey play for English league dem still get three other clubs wey dey play for English Football league.
ยฐ Newport FC na Welsh club but dem dey play for English Football League two
ยฐ Wrexham FC na Welsh club but dem dey play for English Football league two
ยฐ Merthyr Town na Welsh club but dem dey play for seventh division for English Football league
Na only Newport, Wrexham and Merthyr Town Neva play for English Premier league Clubs like Cardiff and Swansea don play and dem too worry clubs for EPL then