William Foulke na Chelsea first ever goal-keeper and some people like am very well despite say na one season hin play for Chelsea.
Dem born William Foulke in 14 April 1874 and dem born am for Dawley, Shropshire, England.William Foulke na professional cricketer and e dey play football too.
Chelsea sign William Foulke in 1905 with ยฃ50 and dem sign am from Sheffield United, William Foulke dey do well for Sheffield United na why Chelsea board rush sign am the bobo even win two FA cup with Sheffield United before Chelsea sign am.
According to some Tori, William Foulke too dey vex if hin defenders no dey play well e go use vex commot for post but that one no mean say e no sabi keep ball.
William Foulke fat very well come tall like giant, Chelsea even put two small pikins for goal-post beside William Foulke make dem dey distract opponents but those boys come still dey help dey go carry ball if ball commot and people believe say na from there ball boy take start.
Despite say William Foulke no dey hear word, e too good dey way e take dey save ball dey surprise people.
For Chelsea first ever competitive match wey be William Foulke first match as Chelsea goal-keeper dey bobo even save beta penalty wey surprise people.
William Foulke play 35 games for Chelsea, concede 25 goals,William Foulke miss 6 games that season and inside that 6 games wey hin miss the goal-keeper wey dey post chop 17 goals.
William Foulke later join Bradford City wey be bin final club and e later die in May 1916 at the age of 42 and na Cirrhosis kill am.