Super Eagles coach wey im name na Jose Peseiro don choke mouth for Victor Osimhen matter for press conference wey dey go on today.
Nigerians don pray tire after dem wake up come dey hear say Victor Osimhen no follow Super Eagles squad travel to Bouakรฉ last night.
Since this 2023 AFCON start na for Abidjan Super Eagles camp and na for Abidjan dem play all their matches but dem go play this Semi final for Bouakรฉ na why dem travel go there yesterday night.
According to Super Eagles medical team, dem say Victor Osimhen no follow others because e dey get abdominal discomfort.
Dem tok say dem leave Victor Osimhen for Abidjan and dem leave am with one medical team member wey go dey monitor am closely and if dem declare fit say e go come join hin teammates before 5pm today.
Di news come make some Nigerians dey feel somehow because Victor Osimhen dey work hard for pitch infact hin presence for pitch dey fear opponent defenders.
But Jose Peseiro wey be Super Eagles coach don finally tok small thing concerning Victor Osimhen injury and e say na for afternoon e go know about Victor Osimhen whether e go join dem or not, Jose Peseiro tok for press conference say:
” The doctors go continue to dey work with Victor Osimhen and confirm hin fitness for di game later in the day.” – via Tobi Samuel
Some reports say make Nigerians no worry say Victor Osimhen go join Super Eagles squad this evening so make people no too worry
Nigeria go meet South Africa tomorrow for Semi final of this 2023 AFCON and di match go shele for Bouakรฉ tomorrow and di match go start by 6pm Nigerian time.