Super Falcons and Barcelona femení Striker wey her name na Asisat Oshoala don come out use vex dey para for people wey dey come beg am money for Dm like say dem give am money make she help keep for dem.
The Super Falcons striker use her Snapchat account dey para dey vex say di begging don too much make dem reduce am because she don tire and wetin dey vex her be say some of dem won use di money do wedding.
According to di post wey she post for her official Snapchat account on Thursday, she say she no go listen to anybody wey come her inbox dey tell her say dia wives don born or dem won do wedding so dem need money.
Oshoala still tell people make dem use dia common sense, make dem know di kind thing wey dem go dey beg am because she get her own responsibility and she get people wey she dey support and help too.
Oshoala na person wey dey help people she even get foundation for Lagos wey she name Asisat Oshoala foundation and people wey know her very well suppose know say she love to dey help people so anything wey make her come online dey para that means di thing don too much.
Asisat Oshoala post for her Snapchat say:
Immediately she drop di post many Nigerians don use dia various Social Media accounts dey react, see dia reactions below:
@NdukaIbekwe say: ” If you get di money still send am, but this mentality from us no good dem suppose stop am, she no dey owe anybody,know this and have peace, Darling no worry I go stop dem, abeg you fit send me 2k make I use stop dem ok”.
@Jahy_Official say: “You wey born no sabi say you go take care of your pikin?,LMAO! Some people ehn”.
@D3estiny say : ” Nothing dey vex me pass my wife just born, you think say I no like to born too?”
@Teesaid say: ” This kind of neck pressing requests for money from person wey dey work hard before e go earn money dey frustrating and stressful”.