Some funny Nigerians don begin dey get double mind after dem hear say na Ghanaian referee go officiate Super Falcons pvs Cape Verde match tomorrow.
Super Falcons of Nigeria go play Cape Verde for 2024 Women’s Africa Cup of Nations final round, first leg tomorrow and di match go shele for Mko Abiola Stadium wey dey for Abuja, Nigeria.
So CAF don appoint one Ghanaian referee wey go officiate di match and her name na Ama Boateng-Nkansah, sister Ama Boateng go be di center referee while Doris Darko go be her assistant referee 1, Alice Chakule go be assistant referee 2, and Barikisu Salifu go be di fourth official(All of dem Ghanaians).
Ama Boateng-Nkansah
Oumou Sy from Guinea go be di commissioner while Medeleine Somda from Burkina Faso go be di referee Assessor.
Nigeria and Cape Verde go play di second leg on Tuesday wey be 5th December and di second leg go shele for Praia.
Na Liberian officials go dey incharge of di game, Sylvina Welma Garnett go be di referee while Hannah Moses go be her assistant referee 1, Precious Amara and Humu Marah wey come from Sierra Leone go be her Assistant Referee 2 and fourth official.
Oumou Souleymane Kane from Mauritania go work as Commissioner while Fadouma Dia from Senegal go be di referee Assessor.
Meanwhile, Super Falcons of Nigeria go play di match without some of dia star players, dem go play di match without, Asisat Oshoala, Jennifer Echegini, Halimat Ayinde, Ifeoma Onumonu, Christy Ucheibe, Michelle Alozie and Plumptre.
Although Super Falcons caretaker wey im name na Justin Madugu don call new people wey go replace dem, people like Peace Efiaz Motunrayo Ezekiel, Chioma Olise and Chiamaka.
This final round of 2024 women’s AFCON qualifiers dey important because na anybodi wey win go follow others go Morocco go play di tournament next year.