Some people never know say e dey possible for three country to qualify for one group in this 2023 AFCON wey dey shele for Ivory coast.
Ghana and Egypt play 2-2 draw yesterday wey make some people come begin dey ask questions whether Ghana fit still qualify for group B because dem dey last for table with only one point, Mozambique come dey 3rd with one point, Egypt come still dey 2nd with 2 points while Cape Verde dey 1st with 3 points because dem win Ghana for their opening group stage match.
Well, e still dey possible for Ghana to still qualify for round of 16 but di only way wey Ghana fit take qualify na through back door wey dem dey call “best losers” in street language or ” four best-ranked third-placed teams”.
See how e take dey possible for team wey carry 3rd to qualify:
โข Na 24 countries dey play this AFCON and dem divide dem into 6 group ( Group A, Group B, Group C, Group D, Group E and Group F).
โข Inside di group na four countries dey Inside and dem go play each other once no second leg or returning leg.
โข After di group stage matches, two country go qualify automatically and di two country na people wey carry 1st and 2nd while di country wey carry last(4th) go commot for di competition.
โข The next phase na round of 16 meaning say na 16 countries go play am so if dem carry all di countries wey carry first and second for di 6 groups na 12 dem go be which means dem still need four more countries to complete dem 16 so that dem fit complete play di round of 16.
โข The only way wey dem fit complete dem 16 na to go pick four countries inside those 6 countries wey finish 3rd for group stage and before dem choose dem, dey go gather di 6 countries come calm down calculate how many points all of dem gather during di group stage, come count goals and goal difference.
โข If dem calculate finish, out of dey 6 teams wey carry 3rd for group stage, dem go carry di four best-ranked third-placed teams with di highest group stage points/goals take complete di 12 countries wey carry 1st and 2nd.
If dem complete 16, others go carry their bags go house while di remaining 16 go come play round 16, after Round of 16, 8 teams go come qualify for Quarter final after that one 4 teams go come qualify for Semi final after di Semi final 2 teams go come play final.