My kwantri people dey tok about fake products shey una don hear about fake national team wey reap Bahrain national team back then in 2010.
I Know say e dey sound somehow but make I throw una back to 7 September 2010 when one fake Togo national team go play match with anoda country.
Na Bahrain di fake Togo national team go play di match with and Bahrain dey prepare for West Asian Football Championships wey go begin on di 24 September 2010 na Im make dem dey find country wey strong wey dem go play friendly match with so that dem go fit use am prepare for di tournament.
The Bahrain Football Association (BFA) say dem don arrange all di usual official procedures, and am dem arrange am through an agent wey dem don know for several years.
The friendly match shele for one Sadium in Riffa, Bahrian and Bahrain later win di match 3-0 wey make Bahrain players come dey wonder which kind Togo dem play with because this Togo players dey run like people wey get belle or ogogoro people because dem no sabi play ball at all.
Bahrain come dey vex say dem don waste money invite country wey no sabi play ball, as di news come dey fly around say Togo lose 3-0 against Bahrain, naso Togo Football Association come dey wonder which day dem play match with Bahrain because dem no dey aware of any match.
Togo sports minister come call Bahrain tell dem say people don reap Bahrain say na Fake Togo play with dem no be di real Togo, e say e fit be agbero wey dem pack for street play against dem.
Even after di match, Bahrain national team coach then wey im name na Josef Hickersberger come tell the Gulf Daily News say:
” Everything seemed to be in order until after the game, when we began to hear that some people are wondering about these players and this Togo team. We ourselves were surprised when we heard this,”
later, Togo FA come dey do investigations come find out say na former Togo coach wey im name na Bana Tchanilรฉ arrange boys for street carry am go play di friendly match with Bahrain and e no tell Togo FA.
Dem later ban coach Bana Tchanilรฉ.