Football fans all over di World don cry tire after dem hear news wey say one Football team bus get beta accident wey kpai some people wey dey inside di bus.
According to reports from some Algerian medias, one Algerian club wey dem dey call Mouloudia El Bayadh Football Club bin get serious accident wey take dey life of dia goal-keeper and assistant coach.
Mouloudia El Bayadh Football Club wey dey 6th for Algeria Football league 1 table bin dey travel on Wednesday wey be 19th December 2023.
Dem dey travel because dem get league match with anoda Algerian club wey dem dey call JSK Kabylie and na important match.
And dem do di driving with bus, unfortunately, di bus come get beta accident for one town of Sougueur in northwestern Algeria, di bus turn wey make people wey di inside di bus get serious injury while some die at di process
Na two people dem confirm say dem die, dem say Mouloudia El Bayadh FC goal-keeper wey dey 27 years die at di process and di goal-keeper name na Zakaria Bouziani, no be only him, oga Khalid Muftah wey be di club assistant coach follow die.
The club confirm say others wey get injury don dey recover small small and dem believe say with time everybodi go get demself.
This thing wey happen don make Algerian FA don suspend anything wey concern football for di country untill further notice.
Algerian Football Association release statement say:
” .”In the wake of the painful tragedy that befell Algerian football โฆ the Algerian Football Federation decided to suspend all football activities scheduled for the end of this week across the entire country”.
The Federation don also decide to postpone the draw ceremony for the 32nd and 16th rounds of the Algerian Cup to a later date.