FA(Football Association) don use vex charge Arsenal coach wey im name na Mikel Arteta because of wetin e go tok for Interview after Newcastle win Arsenal 1-0 for St James Stadium on Saturday November 4th.
After di match, Mikel Arteta bin say that Anthony Gordon goal wey VAR no commot na “Absolute Disgrace” because di goal no suppose stand infact dem suppose commot di goal.
According to the statement wey FA release yesterday, dem say:
“Dem don charge Mikel Arteta with a breach of FA Rule E3.1 because of wetin e go tok for Media interview after Arsenal Premier’s league game against Newcastle on Saturday wey be November 4”
Dem allege say wetin Arteta tok carry misconduct and na insult for where match officials dey infact e no suppose tok that kind thing because e fit spoil something for football.
VAR bin check di goal wey Newcastle bin score very well dem even check three times make dem see whether na goal, dem first check whether ball don commot before Joe Willock cross the ball give Anthony Gordon, after that one dem come check whether Joelinton foul Gabriel after dem check that one finish dem come check whether Anthony Gordon dey offside.
After the whole thing, Mikel Arteta come grant interview dey para say wetin VAR do that day na Absolute disgrace because that goal no suppose stand, even Arsenal release official statement say dem support wetin Mikel Arteta tok dem say PGMOL ( Professional Game Match Officials) suppose address the standard of officiating or make dem try do something because no be every week team or coach suppose dey tok dey explain or dey apologize.
FA give Arteta from now till next week Tuesday make e respond to di charge or make e come defend hin self or else FA go do wetin dey dia mind.