Year never go far but many funny things don dey happen for Nigeria, from one funny story to anoda, from one vawulence to anoda but today own na one woman wey camera capture for Bet9ja shop.
According to di picture wey dey fly around for social media, di picture bin show when one mama wey dress like say she dey go August meeting dey Inside betting shop dey forecast game.
Di mama wey people still dey find who she be bin dey betting shop dey predict dey fire virtual like say she don dey play am for long.
The one wey shock Nigerians na when camera capture when she bend down near laptop like person wey don use contribution money play game finish.
Na this particular picture make some Nigerians come begin dey wonder wetin fit make old woman dey play bet, some even dey ask questions say whether di woman want increase her blood pressure, abi she don use contribution money play virtual betting.
Upto now dem never identify di woman,even @Naija_PR wey post di woman for their official X(Twitter) account never still identify who di woman be..
See di post for down:
Despite say wetin dey woman dey do no good, some Nigerians still dey find her to send her small money make she stop to dey play bet.
See wetin some Nigerians tok about di woman:
@Sanmi say: ” Which person mama be this, abeg tag her child here”.
@B.E.Y.T Accessories say: ” Who know her, abeg bring her account details make we help her”.
@Your Tech Sis say : ” Omo this woman just won increase her blood pressure”.