Two Manchester United players wey be Christian Eriksen and Rasmus Hojlund don withdraw from Denmark squad due to injury wey dem carry on Saturday against Luton.
The two players bin carry injury on Saturday wey make coach remove dem, Christian Eriksen first carry injury around 40 mins wey make Erik Ten Hag commot am put Mason and di injury resemble knee injury .
As second half won finish, e just remain 11 mintues make match finish naso Rasmus Hojlund fall for ground come hold back of hin right leg wey make Ten Hag remove am put Anthony Martial.
After di match finish, Man United coach wey be Erik Ten Hag come tok say:
“For now, I no fit tok anything about the injury because I no know anything about am, we go do assessment and we go wait for 24 hours before we go see the conclusion.”So we go give the medical team 24 hours to see wetin be di problem.โ
Denmark coach don call Jesper Lindstrom of Napoli and Jen Stryger Larsen of Trabzonspor make dem replace di two Man United players wey carry injury.
Denmark go face Slovenia on Friday before dem play Northern Ireland on Monday for Euro 2024 qualifiers.