Everton wey still dey hustle for points dem don run commot 10 points from Everton hand.
Dem say Everton breach Premier league profitability and sustainability rules (PSR) na why dem commot the 10 points so Everton don move from 14th to 19th immediately.
According to the rules, Premier league Clubs no supoose lose more than ยฃ105m “over a three year period” but Everton go lose ยฃ124.5 million( this one na 2021-2022 mata).
Everton say dem go appeal the judgement but as I dey tok Everton dey 19th with 4 points, imagine people wey dey 14th with 14 points yesterday.
Everton next premier league match na Man United and the way things dey go I Everton no dey careful dem fit see demself for Championship next season