Birmingham City football club fans don celebrate tire after dem hear say their club don finally sack Wayne Rooney wey won send dem enter relegation next season.
Birmingham fans never get happiness for the past four months wey their new owners employ Wayne Rooney as their manager.
Na from tears to tears, from one complain to anoda complain e never get time wey dem calm down enjoy their club unlike before wey their team just dey win matches back to back under their former coach wey dem pursue.
Since the beginning of October 2023 wey Birmingham pursue John Eustace carry Wayne Rooney, di club just dey go down.
Wayne Rooney don coach 15 matches, win only 2 matches wey make di club move from 5th to 20th for Championship table and na 5 points dem use dey top people wey dey relegation zone.
After Leeds United beat dem 3-0 yesterday, some Birmingham fans come begin dey protest say make Wayne commot for their club dem dey for all Birmingham Football club comment section dey protest say dem no won see Rooney dor their club again.
So Birmingham City owners don finally decide to sack Wayne Rooney, according to reports from The Mirror, Birmingham City Football club don sack Wayne Rooney after four months wey e don stay for di club.
Dem sack am after e lose 3-0 against Leeds United on Monday wey be 1st January 2024 wey make di club fans dey protest say dem no need am again.