CAF don finally release di 41-man AFCON provisional squad wey Super Eagles coach submit wey some Nigerians don begin dey vex dey ask questions say why Jose Peseiro no add any outfield player for di list.
According to CAF, each country wey dey participate for di AFCON next year go submit a provisional list of no more than 55 players and di deadline day wey CAF give dem to submit am na14 December 2023.
After some meeting, CAF (organizer of TotalEnergies CAF Africa cup of Nations ) come decide say every country wey go participate for AFCON next year dey free to submit a final squad of 27 players, before na 23 players dem carry play AFCON so dem don add am four more.
CAF say di 27 squad no be must oo incase any country still won carry 23 players go say dem fit still carry 23 players play di tournament.
incase a team submit final squad of between 25 and 27 players, only 23 of dem go dey available for selection for each match during di tournament, CAF say di deadline day wey coach go submit hin final squad for di tournament na 3rd January 2024, ten(10) days to the opening match.
CAF still tok say dem no fit replace any play wey make am to di final squad, di only thing wey fit make dem allow make country replace player na unless say di player carry serious injury no less than 24- hours before the team first match and CAF medical committee go first check whether na true say di player carry serious injury.
The tournament go start from 13 January to 11 February 2024 and na for Ivory coast dem go play di tournament and Ivorian coast cities wey dem go play di tournament na Abidjan, Bouake, Korhogo, San Pedro and Yamoussoukro.
See di official 41- man AFCON provisional squad wey super Eagles coach submit:
Francis Uzoho top di list, Ahmed Musa dey too and Some Nigerians believe say Super Eagles go need him experience for di AFCON next year.