Some Nigerians no dey happy after dem hear say Jose Peseiro snub Doma United goal-keeper wey im name na Kingdom Osayi.
Kingdom Osayi dey do well for hin club for NPFL di bobo even do two assists against Gombe United and e don keep 10 clean sheets inside 12 League matches na im make some Nigerians begin hail am say dem go like see am for Super Eagles squad for AFCON next year.
Unfortunately, Super Eagles head coach wey im name na Jose Peseiro don submit hin 55 -man AFCON provisional squad yesterday and Kingdom Osayi name no dey there.
People wey dey organize di tournament wey be CAF (Confederation of African football) tell all di 24 countries wey won participate for next year AFCON say dem go submit a provision list of players at least a month to do tournament, na from di list dem go pick di 27 players wey go play di tournament.
According to Adepoju Tobi Samuel, Jose Peseiro pick Ojo Oloruneke of Enyimba and Christian Nwoke of Sporting Lagos.
/Photo of Christian Nwoke of Sporting Lagos/
E come still pick Francis Uzoho come leave Maduka Okoye and kingdom Osayi na that Kingdom Osayi vex some Nigerians because dem believe say Kingdom Osayi suppose make di 55- man provisional list.
E get anoda new faces wey Jose Peseiro select according to reports, e add Stanley Nwabali of Chippa United, Jerome Akor of Montpellier, Chuba Akpom of Ajax and Alhassan Yusuf of Antwerp.
Although dem go trip di squad to 33 players before di team go travel go UAE go play for tournament wey dem won play on di first of January.