Manchester United go welcome Chelsea for Old Trafford by 9:15 Nigerian time today and dia fans no fit wait for di match to start.
Both Chelsea and Manchester United no too dey in good form this season but dia fans still get hope say today’s match go sweet pass any other match wey dem don play this season.
Manchester United and Chelsea get list of players wey no go play today’s match due to injury and some of dem di dey very important to di both clubs.
Names of Man United players wey no go play today:
Martinez, Tyrell Malacia, Casemiro, Evans, Mason Mount, Christian Erisksen and Amad no go play for Manchester United today due to injury. While Jadon Sancho no follow for di squad at all.
Name of Chelsea players wey no go play today:
Romeo Lavia, Christopher Nkunku, Trevoh Chalobah, Ben Chilwell, Carney Chukwuemeka, Wesley Fofana, Malo Gutso, Ugochukwu and Gallagher ( Gallagher collect red card for Chelsea last match).
As we don see list of players wey no go play today’s match, before we start our prediction make we check Man United vs Chelsea head to head stats.
Some important stats wey you suppose know about Man United vs Chelsea before you drop any prediction.
Manchester United still dey unbeaten in 11 league games against Chelsea since dem lose 1-0 for Stamford Bridge in November 2017 (Dem win 4, Draw7).
The last time wey Chelsea win Manchester United for Premier league away match na May 2013 and the match end 1-0, Chelsea don play six draws, lose four for Old Trafford since then.
โข Manchester United don lose three of their last five Premier League home games.
โข Manchester United no score for half-time in six of their seven home league games this season.
โข Man United never play draw in a league match since dem play 2-2 draw with Tottenham on di 27th April, 2023, dem don draw 13 come lose eight in their last 21 league games.
โข Na only two goals Marcus Rashford don score inside 18 games wey e don play for United this season.
โข Chelsea don lose 16 of their 37 league matches in 2023.
โข Chelsea don win three of their last four away league games.
โข Chelsea just win one of their past 10 midweek matches in the Premier League (Draw 3, Lose 6).
โข Chelsea don lose five of their last six games wey dem play onTuesday, Wednesday or Thursday.
โข Chelsea don play seven league games without keeping a clean sheet,dem concede 16 goals.
โข Chelsea player wey im name na Reheem Sterling never score against Manchester United and e don face them 24 times for league and Cup matches according to BBC.
With all this stats and record wey dey for up e no suppose hard to detect how dey match go take end tonight, my prediction na, Manchester United 1 – 1 Chelsea or you play Under 3.5 to be on the safe side.
Manchester dey 7th for table with 24 points after 14 League games while Chelsea dey 10th with 19 points so both of dem need this match pass anybody but I know see anything wey pass draw for this match.