Super Eagles and Napoli striker wey im name na Victor Osimhen win Serie A player of the year award yesterday night wey make some Nigerians and hin fans dey happy say e deserve am.
The 24 year old Napoli striker bin collect the Italian Footballer’s Association (AIC) Footballer of the year award yesterday night because of his performance wey help Napoli win Serie A title last season and e don become di first Nigerian to win Serie A player of the year award.
Victor Osimhen collect this award for the 2023 Gran Gala Del Calcio award ceremony wey shele on monday night wey be 4th December 2023 and dem dey give out the awards to people wey perform well in Serie A for previous season.
Wetin follow make Victor Osimhen win that award na because e score 26 goals wey help Napoli win their first Serie A title in 33 years.
Although no be only Serie A Footballer of the year award dem give out yesterday, dem give out coach of the year award, goal of the season award, club of the year award and team of the year award.
No be only Serie A Footballer of the year award Victor Osimhen win yesterday, dem still add hin name for Serie A team of the year alongside, Mike Maignan, Giovanni DI Lorenzo, Kim Min-Jae, Andrea Bastoni, Theo Hernรกndez, Stanislav Lobotka, Hakan รalhanoglu, Nicolo Barella, Refael Leรฃo and Khvicha Kvaratskhelia.
In October, dem bin rank Victor Osimhen eighth in the 2023 Ballon dโOr, wey make am the highest-rated Nigerian since dem start dey give Ballon D’or award, na Kanu wey finish 11th in 1996 be di highest before Osimhen top am.
Osimhen performance last season don bring am more fame and awards, dem also nominate Osimhen for the FIFA Best Awards no be only that dem still nominate am for the Globe Soccer Award wey Nigerians dey vote wella make dem see whether e go bring the award home.
Lastly, Victor follow for 10 final people wey dem nominate for the 2023 CAF Awards wey go shele in Marrakesh, Morocco, on December 11, 2023 wey some people say na im go win am because e deserve am.