Super Falcons and Barcelona femení Striker don enter market dey find relationship wey she go dey do Christmas because she no won dey single for this Christmas period.
She no even need one boyfriend, she need three boyfriends, according to her, and she don still use her mouth tok the kind men wey she want.
The Nigerian female professional player say since December don reach say she need like two to three boyfriends and all of dem no go dey for one country.
She say she need one boyfriend for abroad and two in Nigeria, she tok say no be everybody fit apply because she get her own spec oo.
She say na tall and dark men she dey like and di person go get beta money so if you no get money no near her.
Asisat Oshoala tok all this one for her Snapchat account yesterday wey be 1st December, she say:
” .December don come oo,” Abeg where dem dey apply for BF (boyfriend), i go need like 2 or 3 edakun (please) see. 1 abroad, 2 for Naija, Rich niggas only please just be tall oo, preferably dark skin”
See her post for down:
Although everybodi know say na cruise she dey catch but many Nigerians don use dia Social Media accounts dey tok dia own mind.
@Everythinganne_ say : ” If agba baller dey find boyfriend, who kon be me, edakun any tall dark kind guy?”
@Jully_Mk say: ” This lady dey funny oo
@Omolade_junior say : Go for DJ chicken”
@Jboyrug say: ” e pain me na the rich Nigga disqualify me oo even the rich no won the poor if you get the money come dey follow poor girls na you know oo”