Many Nigerians dey vex while some dey para after Nigeria go play draw with Zimbabwe for 2026 Worldcup qualifiers group C match wey shele for Rwanda today.
Nigeria bin play draw against Lesotho for Uyo wey some Nigerians get hope say dem fit win Zimbabwe today make dem see whether dem fit top dia group but wetin Nigerians carry for mind no be wetin dem later see.
The one wey vex some Nigerians no be say dem play draw na the kind goal wey Zimbabwe take score dey vex dem na im make some people dey protest say make Francis Uzoho commot because if dem carry am go AFCON next year say Nigeria no go pass group stage because di way wey dem take dey use freekick score Super Eagles dey fear dem.
Zimbabwe bin use 30 yards freekick score Super Eagles today and di goal don bring some many reactions for social media, some Nigerians say even dia old grandma go save that freekick while some say dem no won tok make Jose Peseiro bench Uzoho or dem sack him and Uzoho.
Watch di freekick goal for down:
Although Iheanacho later equalize wey make dey match end 1-1 but some Nigerians no dey happy because dem dey vex say how dem go take collect only two points against Lesotho and Zimbabwe.
Some use dia X(Twitter) account dey protest dey para say dem no won see Francis Uzoho again for Super Eagles squad again because dem don tire to dey defend am.