Zimbabwe men’s national team coach wey im name na Baltemar Brito don come out dey tell Nigerians and some other countries say Zimbabwe no come play for Rwanda say na winning dem find come because some people dey look down on dem.
Coachie Baltemar Brito tok this one for press conference wey e do yesterday for Rwanda and e tok am with confidence wey make some Nigerians begin dey fear say Zimbabwe coach for don plan dem because dem shock as di coach dey tok with confidence.
When di press conference dey go on dem come ask am wetin e think about dia match against Super Eagles of Nigeria wey go shele for Rwanda today, naso coachie Baltemar Brito use confidence reply dem say:
“For this level, everybodi dey play to win,our opponents dey play to win,even we(Zimbabwe) go play to win against Nigeria”
“People go dey wait make Nigeria revenge because dem play draw with Lesotho but Nigeria no dey play against small or weak nation, Nigeria go use vex and force come, but we go use force come too, we dey Rwanda to face Nigeria”.
Watch di video for down:
Zimbabwe go face Nigeria today for Huye Stadium wey dey for Rwanda and di match go shele by 2pm Nigeria time so some people dey wait make dem see wetin go later happen whether Zimbabwe go win or Nigeria go win dem collect three points.
South Africa bin win Benin Republic 2-1 on Friday wey make dem dey first for FIFA World Cup, qualification CAF 2026 Group C table and anybody wey win inside Zimbabwe or Nigeria go enter first with four points pending on when South Africa go play dia next match.