Flying Eagles wey be Nigeria U-20 men’s national team don give Nigerians better joy after them enter WAFU B Championship final.
Nigeria bin dey lose 1-0 but as soon as dem remember say if them lose that match dem no go play next year U-20 AFCON na im dem use vex do comeback.
Di 3-1 wey Nigeria win against Niger Republic mean say Nigeria don qualify for next edition of di U-20 Africa cup of Nations wey go shele in South Africa next year.
Di winning give Nigerians joy and all thanks to Clinton Jephta wey score two goals and Olalekan Alonge wey score one goal wey help Nigeria beat Niger Republic 3-1 in Lome yesterday.
Nigeria bin start well for first half but na Niger Republic first score Inside 10 mintues wey make Flying Eagles come use vex put pressure to equalize and luckily Clinton Jephta come score before di half time.
Watch di goal
As ball enter second half na im Clinton Jephta come add another goal inside 58 mintues wey help Nigeria dey lead Niger Republic 2-1.
Watch di goal
Nigerians think say na there di goal go end but as ball won finish na im Olalekan Alonge come score another goal for Nigeria to secure their come back.
Watch di goal
Di goal wey Olalekan Alonge score help Nigeria win Niger Republic 3-1 and as dem win e mean say Nigeria don reach final of di WAFU B U-20 Championship and dem don still qualify for next year U-20 Africa cup of Nations.
Nigeria wey be defending Champions go face Black Satellites wey be Ghana U-20 men’s national for final and di final go shele on Wednesday make dem know who go be WAFU B Champions although di two countries don qualify for next year AFCON.