Nigeria’s Golden Eaglets no go follow play 2023 FIFA U-17 World Cup wey go shele for Indonesia because dem no reach the semifinal stage for AFCON U-17 Championship wey bin shele for Algeria earlier this year.
Nigeria bin dey the same group B with Morrocco, South Africa, and Zambia, although dem finish second for the group with six points.
As dem reach quarterfinals, Burkina Faso come win Nigeria 2-1 na why Nigeria no qualify for the 2023 FIFA U17 WorldCup, na di four countries wey reach Semi Final qualify for dis U17 WorldCup wey dey shele for Indonesia (Burkina Faso, Mali, Senegal, and Morrocco) dey represent Africa.
The last time Nigeria qualify for U17 WorldCup na 2019, FIFa cancel di 2021 edition because of Covid-19 pandemic wey worry everybodi.
Nigeria na the most successful country in the history of U17 WorldCup because dem don win am give times, Nigeria win am in 1985, 1993, 2007, 2013, and 2015.
2023 U17 WorldCup don start yesterday wey be 10 November 2023 and e go finish for 2nd December 2023,this one na di first time wey Indonesia go host a FIFA tournament and na di first time wey dem go play FIFA U-17 World Cup for Southeast Asia (dem don play am for Asia country sixth time but dem never play for South-east Asia before).