Di Australian and Chelsea women’s team forward don engage her partner wey her name na Kristie Mewis and na footballer she be.
Kristie Mewis wey dey 32 years confirm dey news give People Magazine after several weeks wey news don dey fly around say two of dem dey date.
Sam Kerr and Mewis don dey date since 2021 and Mewis say she too love Sam Kerr because she dey support her Wella and she dey listen to her despite say she dey give Sam Kerr wahala sometimes, yet Sam Kerr no dey complain.
The first day people begin dey suspect say two of dem dey date na during Tokyo Olympics, wey two of dem meet each other for Bronze medal match, Mewis play for USA women’s team while Sam kerr play for Australia women’s team after dey match, dey two of dem come sit down for field come put hand together as husband and wife.
Three days later, Sam Kerr come use her official Instagram account post where two of dem dey kiss, na be only that day dem dey pepper netizens with love pictures, dem dey pepper people wella.
Mewis dey play for Gotham FC wey dey US league while Sam Kerr dey play for Chelsea wey dey play for Women Super league.
Both of dem even represent dia country for 2023 women’s Worldcup wey Spain win, although Mewis no play any match for di group stage but she follow play penalty against Sweden for round of 16.
early October, Mewis post engagement ring for her Instagram account wey make some people dey congratulate her even her international team mate call am “Australia first lady”.
So Mewis don finally confirm say Sam Kerr don engage her and she even show people magazine her engagement ring.
WATCH DI VIDEO FOR DOWN