2023 AFCON group stage wey shele for Ivory Coast don finally finish yesterday and some people don qualify while some people don already pack their bags dey go their house.
This AFCON na one of the best AFCON best na wetin people no believe come later dey happen and wetin surprise people be say na Cape Verde and Equatorial Guinea top group A and group B wey top countries like Nigeria, Ivory Coast, Ghana and Egypt dey.
How dey group stage take go:
โข Na 24 countries start this AFCON tournament wey shele for Ivory Coast and dem divide dem into 6 groups ( group A,B,C,D,E,F).
โข After all di group matches na 12 countries qualify as first and second while di remaining four countries qualify through best losers (third best placed teams)
โข Equatorial Guinea and Nigeria qualify for group B( Equatorial Guinea carry first while Nigeria carry 2nd).
โข Cape Verde and Egypt qualify for group B (Cape Verde carry first postion while Egypt carry 2nd.
โข Senegal and Cameroon qualify for group C ( Senegal collect first postion while Cameroon carry 2nd position).
โข Angola and Burkina Faso qualify for group D( Angola collect first postion while Burkina Faso collect 2nd).
โข Mali and South Africa qualify for group E ( Mali collect first postion while South Africa finish for second).
โข Morocco and DR Congo qualify for group F( Morocco collect first postion while DR Congo finish second)
Because na 24 countries play di tournament, na 16 countries go play di round of 16, total numbers of countries wey finish first and second for each group dey 12 and di 12 countries no fit play di round of 16 so dem need to carry four countries wey finish third with di highest points or goal difference from each group.
List of countries wey commot for group stage and countries wey qualify through best losers
โข After all di group stage matches, Tanzania, Zambia, Tunisia, Algeria,Gambia, Mozambique, Ghana and Guinea Bissau don commot for group stage.
โข Guinea, Nambia Mauritania and Ivory Coast qualify as third best placed teams(best losers) because dem don calculate di total points and goal difference of countries wey finish third for each group dem come see say na di four countries get di highest points and goal difference.
Round of 16, time, date and venue
โข Nigeria vs Cameroon – 27 January 2023 and di match go shele for Houphouet-Boigny stadium ( 8pm)
โข Angola vs Namibia – 27th January January and di match go shele for Bouake Stadium ( 5pm)
โข Egypt vs DR Congo – 28 January and di match go shele for San Pedro Stadium ( 8pm)
โข Equatorial Guinea vs Guinea – 28 January and di match go shele for Ouattara Stadium (5pm)
โข Senegal vs Ivory – 29 January and di match go shele for Yamoussoukro (8pm)
โข Cape Verde vs Mauritania – 29 January and di match go shele for Houphouet-Boigny stadium (5pm)
โข Morocco vs South Africa – 30 January and di match go shele for San Pedro Stadium (8pm)
โข Mali vs Burkina Faso – 30 January and di match go shele for Korhogo stadium (5pm)
Quarter finals:
โข Anybodi wey win inside Nigeria vs Cameroon go face anybodi wey win for Angola vs Namibia match.
โข Anybodi wey win Inside Cape Verde vs Mauritania go face anybodi wey win for Morocco vs South Africa match.
โข Anybodi wey win for Egypt vs DR Congo go face anybodi wey win for Equatorial Guinea and Guinea match
โข Anybodi wey win for Mali vs Burkina Faso go face anybodi wey win for Ivory Coast and Senegal match.
More to follow..