AFCON wey never reach one week wey e start we don dey hear different Tori up and down from one funny tori to anoda this one na how Ivorian Police take arrest one Ghana fan wey go attack Ghana coach for hin hotel yesterday.
Ghana bin start their AFCON journey with lose after Cape Verde win dem 1-2 for Felix Houphouet-Boignet stadium, Abidjan on Sunday, January 14, 2023.
Cape Verde bin start well for first half wey make dem score Ghana inside 17′ mins although Ghana later equalize but VAR commot am due to Offside.
As second half reach, Alexander Djiku come use beta header equalize for Ghana but Cape Verde later score anoda goal for last-minute after small defensive mistake from Ghana defense.
The lose make Ghana enter last for Group B table and di thing come make some Ghanaian fans dey para while some dey protest say make dem sack Chris Hughton wey be Ghana coach.
According to reports from Saddick Adams wey be Ghanaian Journalist, e report say Ivorian Police bin arrest one Ghanaian man yesterday because of wetin e do after Ghana match.
According to him, e say di Ghana fan bin find Chris Hughton go hin hotel for Abidjan after that Ghana match, dem allege say di man find Chris Hughton make e go attack am if no be some Ghana Diplomats and some securities wey join hand stop di man say di man for don wound Chris Hughton because na vex and anger di man carry come.
Although Ghana national team never tok anything about di matter and dem never still identify di man wey do di thing but Saddick Adams reports say dem don carry di man give Ivorian Police make dem put am for cell knack am 2by2 so that e go fit tok who send am and why e won wound coach wey no do am anything.
See di post for down:
Despite say Ghanaians dey vex for their coach because of how dem take lose match, dem still join hand together condem wetin di fans do some say make dem keep am for cell till dem play di AFCON finish.
See wetin some Ghanaians tok:
DeFrankMenz say: “We should not be discouraged by this game. I believe we can break any teamโs defense if Paintsil, Nuamah, Jordan and Kudus play at the same time. I donโt know how the coach can make that happen but Jordan, Nuamah and Paintsil did great in attack”.
AnnanPerry say: “Chris Hughton asa brutaa but violence is no no no. Ghanaians support with emotions”.
@PhilanUTD shout : “Ivorian Police? Let’s all pray for him cus those people don’t play with convicts. Eiii”.
@iamyourspec say: “He should just resign after the tournament. Such a fraud coach”.