Guinea bin humiliate Super Eagles of Nigeria for Ban Yas Stadium wey dey for Abu Dhabi, United Arab Emirates today na im make some Nigerians dey vex dey para say na this leg na im Super Eagles won take play AFCON on Sunday.
Despite say Super Eagles coach Jose Peseiro use anoda goal-keeper e no still stop Nigeria from losing and how dem take lose without scoring one goal vex Nigerians pass.
See di starting lineups wey Jose Peseiro use today:
Nwabili, Zaidu, Ekong, Osayi-Samuel, 0meruo, Awaziem, Abdullahi, Onyedika, Chukwueze, Simon and Sadiq.
Jose Peseiro decide say e go bench some of hin starting eleven players because e won try new formation na why e still with this lineup.
Victor Osimhen dey bench but e no later play while Victor Boniface no dey bench because say e get small issues wey dem go assess and some reports don already dey fly around say Victor Boniface fit miss AFCON although no official statement from NFF or Super Eagles coach.
How di match take go today:
Super Eagles start well when match start, dem even dey press Guinea but dem no make use of their chances very well.
As ball enter 14′ mins, naso Camara run score for Guinea wey make Nigerians come begin dey wonder wetin happen because everybodi believe say Super Eagles go beat Guinea just as dem take beat one Abu Dhabi local team yesterday.
Referee later give Nigeria penalty around 19’mins but Guinea goal-keeper no allow Moses Simon score di penalty, Nigeria still try to score equalize but Guinea goal-keeper still save one powerful header from Sadiq Umar around 27′ mins of di game.
To make di mata worst, Guinea come add anoda goal around 64′ mins wey follow confuse everybodi especially Super Eagles coach.
Because we still dey find way to score even if na one goal, naso Jose Peseiro use vex put Bassey, Iwobi and Onyeka come commot Onyedika, Omeruo and Awaziem but Guinea no allow di three new players wey im put to do anything.
Moses Simon still get anoda chance to score but Guinea goal-keeper still no allow am score, just as ball won finish naso Jose Peseiro commot Alhassan Yusuf, Chukwueze and Simon come put Aribo, Musa and Lookman but wetin dey happen still dey happen.
The match later end 2-0 and di result don make some Nigerians begin dey doubt whether Super Eagles go do well for AFCON wey go soon start on di 13th January 2024.
Super Eagles players go land Lagos, Nigeria tomorrow evening and Governor of Lagos Governor Sanwo Olu, NFF president and some others go host send off dinner party for Super Eagles players before dem come travel go Ivory Coast wey di AFCON tournament go shele.